Di Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) don yan dem members make dem no dey go work again till Ogbonge Government do wetin they promise dem in June dis year. As e be, resident doctors wey dey train to become specialists go dey siddon for house until govt meet their demands.
Remember for we TV program #TalkingHealthwithDrLaz 2 weeks ago, our guests wey be Presido of Resident Doctors bin yan say government never provide enough Personal Protection Equipment and other promises dem make.
We go follow dis up and give you more tori about di strike.