Home Talk Your Own I dey Hail Una O! Ngozi Okonjo-Iweala to Presido Buhari, Jonathan and...

I dey Hail Una O! Ngozi Okonjo-Iweala to Presido Buhari, Jonathan and Obasanjo as Naija say Bye-bye to Polio Virus

423
0
Dr Ngozi Okonjo-Iweala

Di before before oga Minister for Moni mata for we country, Dr Ngozi Okonjo-Iweala don put two fingers in the air give Presido Buhari, before-before Presido Jonathan and OBJ as dem help pursue Polio virus komot for we kontri. Others wey dey inside di hailing list she post for twitter na di Primary Health Care Development Agency (national and states), Gavi and Bill and Melinda Gates Foundation.

Plenty Naija people wey comment on her post hail am join plus including Rotary Club. Dem say everybodi suppose dey happy because dis one na big achievement.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here