Ekiti State don get tear-rubber Commissioner for Health. Im name na Dr Oyebanji Filani. We see dis tori for inside twi-twi as di helper of Presido Buhari on top media matter, Tolu Ogunlesi post am.
Dr. Filani na di Senior Technical Advisor to di Minister of Health wey just komot office last year, Prof. Isaac Adewole. Na Lasgidi boy sef, because na for University of Lagos College of Medicine im graduate in 2006 before im waka go University of Birmingham for jand go study Health Economics and Health Policy. Before this appointment as Oga Commissioner, him na di Technical Director of huwe – di basic healthcare provision fund wey ogbonge government wan use make primary health care dey kajadly kajad.
Plenty young people for inside twitter dey put 2 fingers in the air for Governor Kayode Fayemi of Ekiti State sake of say im appoint young professionals wey get brain. Our oga for TalkHealth9ja, Dr Laz Eze don send congratulobia message give am for inside twitter. He say he dey hope say im go use im new position to #MakeOurHospitalWork.
[…] out tori yesterday about im […]