Na jollification things for some health centres and hospitals inside Calabar, cross River State as a corps member, Mr. Essien Ekemini Etim gather plenty moni, buy handwashing equipment and hand sanitisers and share am for Covid-19 prevention. According by di tori wey Young Medical lab Scientists Forum bin post for twitter, Mr. Etim even give some materials to di palace of Obong of Calabar.
Di people wey commission di project na di Commissioner of Health, Dr. Betta Edu, di Oga Director of NYSC inside South South Zone, Mr Ayodele Folorunso Omotade, and di State Coordinator, NYSC Cross River State. Alhaji Mohammed nakamba.
We dey give dis better youth gbosa for di good work wey im do.