Home Things wey happen Bloody Day in Enugu as Katakata and Fight Scatter Doctors Election

Bloody Day in Enugu as Katakata and Fight Scatter Doctors Election

1201
0

E be like say na war film dem act inside Michael Okpara Square Enugu yesterday wey be venue of the election of di join-bodi of doctors wey oyinbo call Nigerian Medical Association (NMA). A video wey don go viral for internet show scattering of ballot papers and beating of people as plenty of di doctors bin tear race like Ben Johnson.

According to di informate wey we gather from a member of NMA Enugu wey no wan make we talk im name, di thing wey cause di fight na because dem no wan make members wey dey owe dues vote for di election. We gather say di fight extended to Toscana Hotel Enugu wey some doctors and thugs go scatter and tear ballot papers.

Plenty doctors and Naija people for social media dey condemn di fight, say na shameful thing say doctors dey fight break head on top election matter. Last month, fight happen inside Akwa Ibom during di NMA election. Jaga jaga things don too dey happen for we kontri.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.