Home Covid 19 Who Carry Craze Attack Federal Medical Centre Lokoja? See Tori Wey We...

Who Carry Craze Attack Federal Medical Centre Lokoja? See Tori Wey We Don Hear!

686
1

Kontri people, di kind thing wey dey happen inside Kogi State na mata wey dey pepper for ears and turn belle join but we must tell di tori. Early dis morning, we hear say some men wey carry guns without uniform use 3 tear rubber hilux motor enter di Federal Medical Centre Lokoja in a commando style begin scatter things. According by a staff of di hospital wey no wan make we use im name, di men dey shoot guns anyhow, thief laptops, phones and scatter files wey get patients records. Dem also enter di office of di oga Chief Medical Director of di hospital go destroy and thief plenty things.

Wetin cause am? We hear say bodi-mata workers inside di Federal Medical Centre dey arrange to do peaceful we-no-go-gree waka and talk to tori people to help beg ogbonge govt to build lab for di testing of Covid-19 inside di hospital. Dem wan do dis waka because di Kogi State Govt no wan test anybody for Coro according by NCDC guidelines. But na as dem dey prepare for dis na im thugs come scatter area for inside di hospital.

Pesin wey see as e take happen korokoro yan us e be am like say na James Bond film im dey watch. He talk say plenty bodi mata workers bin do Ben Johnson make dia own no loss throway. As things be, we hear say all di doctors, nurses, record people and everybodi wey dey work inside di hospital dey for hiding with fear, and di hospotal don close till further notice.

We bin send questions on di mata to Commissioner for Health for Kogi State, Dr Saka haruna to know how di state govt wan take care of di abandoned patients inside di hospital but im neva answer us at di time we dey write dis tori.

1 COMMENT

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.