As Coro still dey spread inside obodo Naija and other parts of obodo world, di National Coordinator of diseases wey no dey port from pesin to pesin wey oyinbo call Non-Communicable Diseases (NCD), Dr Nnenna Ezeigwe yan say di only vaccine wey dey now na prevention, diagnosis and early treatment of those kind diseases. Some examples of di diseases wey no dey transfer from pesin to pesin na diabetes, hypertension, cancer, heart failure, lung diseases, and asthma.
Dr. Ezeigwe bin talk dis one for a post she made on her LinkedIn page recently. She talk say every evidence show say na people wey get non-communicable diseases wey Coro dey kill pass. Therefore, prevention and early treatment of NCDs na di “only vaccine” wey dey for now to prevent people from dying from Coro, until di main vaccines wey go prevent Coro completely go begin show face.