Home Things wey happen #MakeOurHospitalWork Campaign don Appoint State Team Leads

#MakeOurHospitalWork Campaign don Appoint State Team Leads

517
1

Di group of Naija people wey dey jinja make every hospital or health centre for we kontri dy function kajadly wey dem call #MakeOurHospitalWork Campaign for oyinbo don get new leaders for some states. According by di message wey di national oga, Dr Laz Eze send wey reach our hand, di 15 people wey dem appoint to lead for inside 15 states show say dm dey willing to put jinja for di body of other members to achieve the goals of di campaign.

Acting State Team Leads for MakeOurHospitalWork Campaign

Dr. Eze talk say dem go confirm dm after 3 months based on how dem dy do their work. He also talk say opportunity still dey for di other 21 States and FCT make members wey wan lead show interest. He thank them for volunteering to do this work wey dey importankpa for we kontri.

Di #MakeOurHospitalWork campaign get 629 members wey dey live for all di 36 States of Naija, Abuja, UK, USA, Rwanda and Malaysia. Every member dey work with dem community to make dem hospital dey kpoikally kpoi kpoi.

1 COMMENT

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.