The Ogbonge Ministry of Money, Budget, and Kontri-wide Planning don appoint bodi-mata sabinus Dr. Nkata Chuku as a member of di committee wey go write a new plan for di development of obodo Naija from 2021 reach di year 2050. According by di letter of appointment signed by di Minister of State – Prince Clem Agba, Dr. Chuku follow for Health and Nutrition Technical Working Group wey go prepare di Medium-Term National Development Plan (MTNDP) 2021–2025 and di Nigeria Agenda 2050.
Dr. Chuku na Founder of ogbonge health company, Health Systems Consult Limited (HSCL) and he get more than 15 years experience as expert for health sector. Na him dey lead di health policy commission inside Nigeria Economic Summit Group (NESG). He bin contest 2019 election under Alliance for New Nigeria (ANN) to represent di good people of Ohaozara/Onicha/Ivo Constituency of Ebonyi State inside House of Representatives.
Congrats Dr. More wins
Congratulations to you Dr Nkata
Nka bu nke anyi
Wow, that’s very good to hear, am happy.
My son go on as God will guild u till the end