Di General Hospital for Onicha in Onicha Local Government of Ebonyi State don dey shine like fine babe as di state government don put new beds, suction machines and plenty other hospital equipment dem. According to di torchlightment wey our tori pesin do, di state government bin don fence di hospital, do di inside roads and install solar light to make sure say light dey there 247.
Many Ebonyi people dey hail di work wey government don do for di hospital but wan make government put ice for di sweet cake by employing many bodi-mata workers. Barr. Chukwuemeka Eze wey be ogbonge expert on tax mata say na “good step forward”. Dr. Nkata Chuku wey be ANN House of Rep Candidate for Ohanivo Consitutency in 2019 election, talk say di work sweet im belle. He wan make di govt employ more health workers join di fine hospital and pimp plenty other hospitals and schools. Mr. Kingsley Ibemgbo say di work show say Gov. David Umahi dey hear di complain from people wey want make he do better things for health and education in di state.
Di TalkHealth9ja Oga, Dr Laz Eze hail di state government for di new equipment but come give dem list of di number of bodi-mata workers dem suppose employ for di hospital. Di list na 3 medical doctors, 4 nurses/midwives. 2 medical lab scientists, 2 pharmacists, 1 dentist, 1 accountant, 3 records officers, 4 security people, messengers, cleaners, etc.