Di Nigeria Immigration Service (NIS) don put coma and scatter di plan of 58 Naija medical doctors wey don dey Lagos airport to port komot go obodo oyinbo United Kingdom. Dem say di approval for di plane na to carry 42 doctors go UK for training but dem carry 56 doctors wey no get UK visa and 2 doctors with visa wan waka before immigration say STOP THERE!
Immigration people talk dis one for di statement dem give tori people last weekend signed by DCI Sunday James on behalf of dia oga patapata, Muhammad Babandede. Dem say Immigration Act 2015 give dem power to stop di traveling of anybody to obodo oyinbo if di waka get kurukere. Dem say Federal Ministry of Health no yan dem anything about di waka.
As di 58 doctors carry serious vex dey go back dem houses, di plane fly empty back to London.