E be like say Covid-19 fight don land two Commissioners for Health – Dr Betta Edu of Cross River State and Dr Saka Haruna of Kogi State, for trouble. Di ogbonge join-bodi of medical doctors for Naija – Nigerian Medical Association (NMA) dey jinja to carry two of dem make dem face trial inside medical tribunal idf dem continue to dey use politics dey fight Coro instead of science. Na di oga presido of NMA – Prof. Innocent Ujah talk dis one last weekend.
NMA Presido dey paravex and accuse di two commissioners of talking and behaving anyhow without following NCDC guideline to fight Covid19 thereby putting lives of doctors, other health workers and Naija people in danger. This one, according by Prof. Ujah, mean say dem don carry dem professional oath and medical ethics dey pooh pooh on top am. He talk say enough is enough as NMA no go allow dat one continue. Dem also accused di Governors of di two states of playing with di life of dem people and called on Presido Buhari to draw dem for ears make dem sit up.
We bin send message to di Kogi Commissioner for Health, Dr Haruna to guage how he bin see dis talk by NMA presido, but he never anwer us.
[…] last weekend, di NMA Presido, Prof. Innocent Ujah bin say di association fit carry Dr. Haruna and di Cross River Stat… NMA bin talk say dem dey play politics with di serious mata of Covid19 for dem states and e dey […]