Home As e de hot Clear Conscience No Dey Fear Any Accusation! Kogi Health Commissioner reply NMA

Clear Conscience No Dey Fear Any Accusation! Kogi Health Commissioner reply NMA

475
0
Dr Haruna - Kogi Health Commissioner

Di Oga Commissioner for Health for inside Kogi State, Dr Saka Haruna don talk say im no fear anybody because “clear conscience no dey fear any accusation”. He talk dis one in reply to di Nigerian Medical Association wey sama am accuse of behaving anyhow on top di fight against Covid19 inside Kogi State.

For last weekend, di NMA Presido, Prof. Innocent Ujah bin say di association fit carry Dr. Haruna and di Cross River State Commissioner for Health go trial for Medical tribunal because dem no take di mata of fighting Coro seriously. NMA bin talk say dem dey play politics with di serious mata of Covid19 for dem states and e dey danger di life of doctors, other health workers and Naija people.

Dr. Haruna believe say nothing dey happen as im conscience clear like pure water.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.