As e dey hot tori wey reach us na say di Oga Minister for Abroad Matters, Mr. Geoffery Onyeama don carry Coro wey oyinbo call Covid19. According by wetin he post for im twitter account today, Mr. Onyeama talk say im do Coro test as im throat dey scratch am and e come out positive. He talk say di na di 4th time im dey do Coro test but na dis one turn positive.
As you dey read dis tori, di Oga Minister don dey waka go isolation in a hospital for im treatment. Plenty Naija people wey comment for di mata on top twitter dey wish am sharp sharp recovery. We sef join dey wish Oga Minister sharp sharp healing.