Home MakeOurHospitalWork We No Stop Treatment bcos of Coro; We Dey Do Our...

We No Stop Treatment bcos of Coro; We Dey Do Our Best for Our Cancer Patients – UNTH

475
1

The University of Nigeria Teaching Hospital (UNTH), Ituku-Ozalla, Enugu State don talk dem own about our tori on di complain of 20 years old cancer patient. Dem talk say dem no stop treatment of patients bcos of Coro, and no be true say dem cancer treatment machine break down.

Marvelous Uguru

According by one cancer specialist wey follow us talk but no wan make we mention im name, di hospital don try well well for di treatment of 20 years old motherless Marvelous Uguru wey cancer dey suffer. Di doctor talk say dem begin radiotherapy treatment of di patient in March and plan to do operation for am but Marvelous “disappear” after she get better small. But dem start treatment for am again last week even on public holidays.

From wetin we see about dis matter, di doctors and counselors suppose siddon talk well well with Miss Uguru explanate wetin dem dey do for am and why. Dem suppose hear her own side too make dem know as dem go take help am.

1 COMMENT

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.