E be like say di strike by resident doctors no go end anytime soon as resident doctors still dey lament about di absence of face masks and other protection equipment. Di 1st National Vice Presido, Dr. Julian Ojebo say na for inside television dem dey see N95 face mask wey WHO recommend for use by bodi-mata workers. Although he no mention di health minister name, plenty doctors dey accuse Dr Osagie Ehanire of using N95 face mask for press briefing when dem no get am inside operation theatre to use.
Dr Ojebo also talk say government people don promise and fail dem plenty times so tey dem no trust dem again. He talk say na only action fit convince dem now because lies don too much. Na for inside Channels TV he talk dis one when dem dey ask am questions.
However, bodi-mata minister, Dr. Ehanire squeeze face say Naija na di only kontri in the world wey doctors dey go strike for dis kind time. He say no be for only Naija wey protection equipment no dey because plenty other countries dey face di same wahala. He say di PPE wey dem order go land Naija tomorrow.