Home Things wey happen Resident Doctors fit go Strike from 15th June, See Why

Resident Doctors fit go Strike from 15th June, See Why

494
0

Di join-bodi of doctors wey dey train to become specialists for Naija wey oyinbo call National Association of Resident Doctors (NARD) dey vex. And dem fit begin stay for house without work from Monday 15th June if ogbonge and state government no do wetin dem wan. Dia presido, Dr. Sokomba Aliyu talk dis one last weekend after dem finish meeting with dia 74 chapter Ogas.

According by Dr Aliyu, dem no happy at all as government and some hospitals dey treat dia members like say dem wear dia clothes upside down. See di list of things wey dem want make e happen to prevent dem from gpoing on strike;

  1. Make ogbonge and state government provide enough protection equipment for dem members make dem no catch Coro.
  2. Make Jos University Teaching Hospital (JUTH) call back 26 of dem members wey they sack in a wuruwuru way
  3. Make every hospital wey dey train resident doctors dey do am according by law wey ogbonge govt don do. Dis law na di Medical Residency Training Act 2017.
  4. Payment of di new Hazard Allowee wey govt don approve since April 2020
  5. Stopping of “wuruwuru deduction or cutting of doctors money” as Kaduna State govt don do.
  6. Payment of all di money govt dey owe dem like gbese of minimum wage

Di resident doctors wan make govt begin shake bodi to employ more doctors and other health workers inside different hospitals for we kontri. Dem say di ice water wey govt fit pour for mind wey hot with vexation na by doing all di things dem don list.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.