Todey June 12 no be only democracy day o. For inside obodo world, na International NASH Day! (no be nyash o). NASH na short form of Non-Alcoholic Steatohepatits. Na disease wey dey occur when fats too plenty for inside di liver. E dey happen to people wey fats too plenty for dia bodi like di orobokibo (obese) people.
NASH dey happen to people we carry pot of fats inside dem belle (a.k.a pot belly) and people wey get Type 2 diabetes wey dem body no fit control sugar and fats again. NASH dey also happen to people wey get disease oyinbo dey call Metabolic Syndrome. Dis na disease wey blood pressure, sugar and bad fat for bodi too high.
For inside obodo Naija, na Lafiya Wealth Initiative dey mark NASH day. For dem back na Global Liver Institute. Na Oga Hon. Muhammad Usman, Dr. Laz Ude Eze, Dr Ibrahim Mamman and Mrs Amarachi Iheonunekwu na di people wey dey for dis NGO wey dey work for di betterment of Naija people.