The National Association of Nigerian Students NANS say the way wey people dey rape up and down, for inside Naija don tooo much, them beg the wife of Naija Prezido, Aisha Buhari to put eye for inside the matter.
NANS spokesman, Azeez Adeyemi, yan tori people say e go mke sense make Naija First Lady investigate the matter wey dey go on right now, because number of by force minimini-wanawana cases don increase and them dey kill the victims.
The students union come use the opportunity beg the Aisha Buhari to ginger make them do law wey go put capital punishment untop by force minimini-wanawana for inside Naija.
Say make the wife of the president ginger the first ladies for the states inside Naija, female legislators, civil societies and other well-meaning Nigerians to join the fight against by force minimini-wanawana.