Home Things wey happen Jollification Everywhere as Naija says Bye-bye to Polio Virus, WHO confam am!

Jollification Everywhere as Naija says Bye-bye to Polio Virus, WHO confam am!

660
0

No be small jollification dey for obodo Naija especially among bodi-mata experts as di join-bodi of bodi-mata for obodo world, World Health Organisation don confam say polio no dey Naija again. According by a tweet by WHO Nigeria yesterday, dem say di African Regional Certification Commission (ARCC) don accept “Nigeria’s complete documentation for #WildPolioVirus free status”. E don reach 3 years since last show face inside Naija.

Plenty Naija people dey celebrate dis tori on top social media. Sabinus on top immunisation mata, Dr. Chizoba Wonodi shout with happiness, “We made It!”. She give tuale to Federal Ministry of Health, National Primary Health Care Development Agency and some other people wey she mention. Alabi Michael say di no polio record for 3 years na because of the working together of different stakeholders. Aniedi Udofia beat hand for chest say “I know say I follow make dis happen. Small honest work dey create bigger impact”.

With dis WHO confirmation, e mean say na only Afghanistan and Pakistan wey polio still dey for inside obodo world. We sef follow dey jollificate on top dis mata, congratulobia Naija!!

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.