Home Covid 19 If Pesin Mess and You No Smell Am, and Banana No Get...

If Pesin Mess and You No Smell Am, and Banana No Get Taste For Your Mouth, Coro Fit Dey Your Body – NCDC

863
0
NCDC Oga - Dr Chikwe Ihekweazu

Kontri people, anoda tori don komot about how Coro fit dey show for pesin body. Di Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) don talk say sudden disappearance of ability to smell bad mess or perfume fit be sign of Coro infection. Dem also talk say sudden disappear of ability to taste sweet banana or bitter leaf, fit be say Covid19 don dey inside body. Dem talk dis one for inside tw-twi and also during talk talk of Presido Task Force with tori people inside Abuja today.

Oga Chikwe Ihekweazu of NCDC talk say anybody wey feel loss of smell or taste, or wey get fever, cough or difficulty in breathing not caused by other diseases should call dem state hotlines for sharp sharp Coro testing. He also beg everybody to take responsibility and play dem part towards coro prevention.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.