Former Federal Lawmaker, Dr. Dakuku Peterside don yan Rivers state government say make them set up more testing Centers inside the state because of the way Coro case dey rise like garri wey dem put inside hot water.
Dr. Peterside, na the before-before Director General of the Nigerian Maritime Administration and Safety Agency, him say every Federal constituency of the state suppose get testing center.
Peterside yan this as Gov. Wike put lockdown ontop Bonny Local Government Area and Onne in Eleme Local Government Area of the state, because the number of people wey test positive to Coro bokku for that area.
Him come say, them suppose jinja the people of the state make them by their self waka enter these testing centers to do Coro test.
Because Lockdown no go gel if them no take am do better contact tracing.