Home MakeOurHospitalWork Doctors’ Strike Dey Cause Too Much Sufferness for Naija Patients – #MakeOurHospitalWork...

Doctors’ Strike Dey Cause Too Much Sufferness for Naija Patients – #MakeOurHospitalWork Campaign

887
0

Since yesterday wey resident doctors inside di whole of Naija start strike because say governtment no meet dem demand, na suffer suffer wey patients everywhere for we kontri dey suffer. dis na wetin di #MakeOurHospitalWork Campaign dey talk.

Di Convener for dis campaign wey dem launch yesterday, Dr Laz Eze talk dis one during an interview with one television wey we monitor. He talk say with dis strike, hospitals no fit work especially for ordinary Naija people wey no get moni to pay for private hospitals. He say govt no suppose allow di strike to happen because na protection equipment be number one thing these doctors dey ask for make Coro no kill them again.

He talk say di #MakeOurHospitalWork Campaign get more than 400 members wey dey every state for we kontri and wan join hands with different communities to make dia hospitals and health centres dey kpoikally kpoi kpoi.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.