Home Covid 19 Covid19 Prevention: Face Shield Alone, Babu! Face Shield and Mask, Carry Go!!...

Covid19 Prevention: Face Shield Alone, Babu! Face Shield and Mask, Carry Go!! – NCDC

509
0
No wear shield alone like Gov. Wike, wear mask like Gov. Obaseki and you fit add shield to am.

Do Oga DG for NCDC, Dr Chikwe Ihekweazu talk say face shield alone no fit provide adequate protection agaiinst Covid19. He say science torchlightment show say face mask, handwashing and physical distancing dey protect well but people fit wear face shield join as jara. He talk am today as Oga Presido Coro Task Force dey lingua with tori people inside Abuja.

Gov. Ayade and di doctors wear am correct as NCDC talk, face mask plus shied.

You go don see on TV as plenty governors and other top top people dey wear only face shield dey waka about. Oga Chikwe talk say dat one alone no fit fit protect dem well if pesin wey carry Coro cough near dem. Our finding be say Coronavirus fit still go under the shield enter pesin nose, but mask go help wedge some or all of dem.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.