Di wahala of Coro denial wey Kogi State Govt dey do still dey cause plenty problems for di state. Different bodi-mata workers for di state wey follow our tori pesin talk dey accuse di state govt of not allowing ambulance to dey carry sick people go Abuja from Lokoja. Dem say di governor through his appointees mount agents wey dey for road dey block and turn back any ambulance wey carry sick pesin wan go Abuja for better treatment.
Source wey we trust talk say one nurse for FMC Lokoja don kpai with hotness of body and difficult to breathe. Nobody know whether she get Coro or not as dem no do test, but she bin get sugar disease before. Health workers dey panic for inside Kogi State as everybody dey fear say dem fit carry Coro anytime.
You remember say di state dey follow NCDC and ogbonge govt fight on top Coro mata. Di govt say dem no get any case of Covid-19 and dey point accuse give NCDC say dem wan give Kogi people Coro by force. NCDC don deny di accuse since. Di state also dey vex for FMC Lokoja because dem wan dey do Coro testing by themselves.
Di mata for Kogi don pass don’t be silly. E better make dem komot hand of monkey for soup before e go turn human being hand.