The Seke of di ogbonge govt and Chairmoo of Presido Task Force for Coro, Mr. Boss Mustapha talk say states wey no taka di mata of coro testing seriously dey play with fire. He talk dis one when dem follow tori people talk today.
He squeeze face give many states wey no dey take di mata of testing seriously. He gave example say all di 5 states for South East bin test only 1,625 people as at 1 week ago (1st June). Oga Mustapha draw im ear talk say no bi small danger dey wait for states wey dey do like dat because when yawa go ghast, dem fit no cope. He conclude say di thing wey go help for di fighting of Coro na testing, testing and testing!