Home Covid 19 Coro Confusion in Cross River State as Argument between Govt and Health...

Coro Confusion in Cross River State as Argument between Govt and Health Workers Enter Next Level

616
0
Gov Ben Ayade

Kontri people, no be small confusion dey inside Cross River State since dem Gov. Ben Ayade dey compete with im Kogi brother, Gov. Yahaya Bello on who go carry first for Coro denial. The latest na say di University of Calabar Teaching Hospital announce say dem confam one case of Covid19 for di hospital. Di State Commissioner for Health, Dr Betta Edu say na lie. According by her, di test wey dem do no correct. For di press release she komot, she say di state go torchlight di mata and report wetin dem find to di public.

You remember say join-bodi of doctors wey be Nigerian Medical Association for di state don raise alarm before before say people dey kpai with symptoms wey resemble Coro but di state government no wan make dem dey test dem. Di join bodi of Medical Laboratory Scientists for di state don komot their statement signed by dem Chairmoo – Mr. Ndem Benedict and Secretary – Mr Dennis Ekpo. Dem lament how Coro testing for di state dey very low (9 persons on 10th June 2020) despite plenty samples wey dem don send to di govt people. Dem say people dey waka for di state like say nothing dey happen but plenty people don dey show Coro symptoms inside di state. Dem wan make massive testing begin for di state even without di support of di state government because as dem 2 elephants (Cross River Govt and NCDC) dey fight, na grasses (di people) dey sufer am.

We wan ask, for how long wey Cross River State Government go dey suffer from dis Coro Denial Syndrome?

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.