The before before Senator wey dey represent Kogi West, Senator Dino Melaye con carry vex go Federal High Court inside Abuja. Di mata wey he carry go na make dem give order stop the Speaker of the House of Represent, Hon. Femi Gbajabiamila from passing di Infectious Disease Control Bill wey pass 1st and 2nd reading in one day. Three days ago, Oga Dino bin don talk say na “evil and satanic” bill wey dem wan use scatter di rights of Naija people.
Other people wey Dino join for the court mata na the Clerk of National Assembly, Clerk of House of Rep, Attorney General for Naija and Oga patapata for Police (IGP). He tell court say di bill go scatter all im rights wey 1999 Constitution give am if dem no stop dem.
See di copy of court paper wey Dino share with tori people.
How you see dis mata?
[…] law don dey cause katakata for we country so tey former Senator Dino Melaye don carry di mata go court for Abuja say make dem give order to stop di law with immediate […]