Di wahala wey Covid-19 don dey cause for we kontri no be here o. Ms Marvelous Uguru dey only 20 years old but breast cancer don dey show am pepper since 3 years year. Her cry don reach we ears because she talk say she no happy at all di way her treatment dey happen for di University of Nigeria Teaching Hospital (UNTH).
Ms Uguru tell our tori pesin say na for March 2020 her radiotherapy treatment start for UNTH but dem stop when Coro show face after dem give am 2 out of 28. One NGO, Pink Oak Cancer Trust bin don help am pay complete for her treatment. She rent house dey stay for Enugu for di treatment because her bodi no fit carry di wahala of going from Ebonyi everyday. After plenty visit to di hospital wey dem do plenty test without treatment between April and last week, dem kom begin treatment again from Monday 25th May.
Today today, UNTH talk say dem cancer treatment machine don spoil. Ms Uguru say dis one no be di 1st time wey di machine dey spoil since she start her treatment o. She say she no fit sleep again and she no wan die bcos plenty people don help am make she fit dey alive. She dey beg kontri people to help am beg UNTH make dem treat her well pursue di cancer for her bodi. Her mama don kpai and her papa no get moni.
But doctors wey dey treat am for UNTH talk say her talk no be true. See di full tori here.
[…] University of Nigeria Teaching Hospital (UNTH), Ituku-Ozalla, Enugu State don talk dem own about our tori on di complain of 20 years old cancer patient. Dem talk say dem no stop treatment of patients bcos of Coro, and no be true say dem cancer […]