Professor Maurice Iwu don say the problem wey Herbal medicine dey face na because government no support am and Naija people no dey gbadun local products.
Profesor Iwu na the chairman of the Imo state government Covid19 management committee, him say people go soon start to use herbal medicine wella, when them see say e good for body.
Iwu say, Department of Traditional and Alternative Medicine sev dey Federal Ministry of Health, e just remain make government support am well.
Our system know say Herbal medicine dey, the problem be say our people no dey believe things wey come from our country.
Prof. Iwu come say, if person say him get herbal cure for any yama yama diease, them suppose find time look into am, no be just to use mouth spoil am. If the cure no good enough, them go improve am.