The Director general of Nigeria Center for Disease Control NCDC, been send response team to Kogi to go check wetin dey occur, after reports of people wey dey kpai inside the state.
The governor of Kogi state, Yahaya Bello don dey aware of this development and although him dey ready to allow them operate inside Kogi state but him don tell them say make them go into 2 weeks compulsory isolation.
Bello say na according to World Health Organization WHO direction say, make people wey dey come from outside state or outside country to go into two weeks compulsory isolation.
Him say na either NCDC team go into the 2 weeks isolation or make them leave Kogi state.