Na Kogi State carry last and Cross River State follow am for back like housefly dey take follow bad odour, on top testing for Coro inside obodo Naija. According by the report card wey Naija Centre for Disease Control (NCDC) komot on 17th May 2020, Lagos carry first with 14,886 tests, Abuja carry 2nd, while Kano carry 3rd for highest number of testing wey dem don do since Coro show face for we country.
Na only one test wey Kogi don do. We bin hear say na dem governor be di only pesin wey don test for di state. E fit be dat time wey dem torchlight all governors wey get contact with before before Chef of Staff to Oga Presido Buhari, Mallam Abba Kyari wey Coro don send to meet im ancestors.
See di NCDC testing report for here;

Plenty health workers wey follow us talk for Kogi dey vex well well say di state government no dey allow for Coro testing inside di state. In short, dem say dem fit “take dem destiny into dem hands” if testing no start for di state.