Wahala dey for inside Kogi State now as dem doctors talk say dem go “take dem destiny into their own hands”, wey mean say dem fit decide not to work again. Wetin dey shele for there? Dem complain say dem dey di danger of carrying Koro as di state government no dey allow for testing of people wey dem dey suspect.
According by informate wey we gather during background torchlightment, plenty doctors and health workers wey no wan make we mention dia names talk say dm don tire. In short, say dem feel like not going to work again because say Governor Yahaya Bello no dey allow make di state health people dey test anybody for Koro. Dem dey fear say dem fit carry di Koro from dem patients go give dem families for house or even other patients wey dem dey treat.
When we ask di Presido of Resident Doctors inside Federal Medical centre Lokoja, Dr. Nnanna Agwu, he talk say fear bin catch dem since last week as one doctor bin sick with symptoms wey wan resemble Koro. He talk say di jerking up of mind among doctors for im hospital no be here and water don dey pass garri.
Dr. Agwu come tell us more things with plenty grammar, ““One cannot underestimate the impact of this disease on the lives of the families who have lost loved ones to it. As at today across the country 603 doctors have been exposed, 149 confirmed positive and 7 deaths recorded. We in FMC Lokoja do not wish to be joined in these statistics”.
Wetin una want? We ask am. He talk say make Ogbonge Ministry of Health and Presido Task Force on Koro help make testing begin dey happen for Kogi State with immediate alacrity.
Kogi State government bin don talk say im dey look NCDC with one kain eyes on top dis Koro mata. Dem governor bin say some weeks ago na “mobile app” wey be internet something dem dey use pursue Koro for im state. How you see this mata wey dey happen for Kogi?