Home As e de hot As E Dey Hot: Coro Cases Don Enter 3145, As NCDC Send...

As E Dey Hot: Coro Cases Don Enter 3145, As NCDC Send People To Go Check Wetin Dey Occur For Cross River And Kogi.

405
0

The Nigeria Centre for Disease Control NCDC, don announce 195 new cases of Coro inside Naija, this one come bring the total number of cases to 3145, them don discharge 534, 103 don kpai.

For inside the 195 new cases; 82 dey Lagos, 30 dey Kano, 19 dey Zamfara, 18 dey Sokoto, 10 dey Borno, 9 dey FCT, 8 dey Oyo, 5 dey Kebbi, 5 dey Gombe, 4 dey Ogun, 3 dey Katsina, 1 dey Kaduna, 1 dey Adamawa.

Because of the reports about how things dey go down for Kogi and Cross River, some people wey don kpai, and say testing never dey go on, NCDC don send people to go check wetin dey happen, follow the state governments rub mind, make things for fit start go well.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.