Home Covid 19 4 Weeks after dem promise Testing 2000, na about 200 people Ebonyi...

4 Weeks after dem promise Testing 2000, na about 200 people Ebonyi don test for Covid19

593
0
Governor for Ebonyi State, Engr. David Umahi

Wetin dy delay Koro testing for inside Ebonyi State? On 20th April 2020, di state governor, Engr. Dave Umahi bin announce say dem go dey go house to house for inside village dey test people for Koro. Governor Umahi bin promise say na 2000 people dem go test within 14 days. Plenty newspapers, radio and television sef carry di tori. Di state bin collect some accolades sef from bodi mata people.

Today na 20th May; 30 days don pass but na just about 200 people wey Ebonyi State don test of which 13 dey Koro positive, according by report wey NCDC don komot. NCDC bin set up testing lab for Ebonyi and dem don dey do test since 1st of April. Ebonyi State, wetin dey happen?

Look below to see how many tests each state don do.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.