Today no pure for Mr. Chijioke Agwu, tori pesin for The Sun newspaper for Ebonyi State as im dey cool off now inside police detention as dem kolobi am today inside Abakaliki. According by tori wey reach us, Governor David Umahi of Ebonyi State bin vex well well about di torchlightment tori wey he write on how Lassa Fever dey cause kasala for the state. The tori wey The Sun publish yesterday yan say jerking up of mind dey well well for Ebonyi State bcos of how people dey take catch or die from Lassa Fever. Government talk say na fake news im write.
One adviser to Ebonyi Governor wey support di arrest talk say dem invite am to security meeting to yan government names of the people wey talk say Lassa fever plenty for Ebonyi but he no gree. E be like say Ebonyi government go carry am go court wey dem go sama am with the Ebonyi State Infectious Disease (Emergency Prevention) Regulation.
Ebonyi na one one of the 3 states for Naija wey Lassa Fever cases brekete pass, according by NCDC report. Plenty kontri people on social media don dey react with vexation to dis arrest of Mr. Agwu for doing im work.
[…] bin report about di kolobi of Mr. Agwu by Ebonyi Police with the order of di state governor. See di tori wey […]
[…] Lassa Fever dey kpai people for Ebonyi State bcos na im state wey he love too much. Mr. Agwu wey Ebonyi Governor order im arrest last weekend and wey follow for di two journalists wey im “ban for life” 2 days ago from any govt […]