Ogbonge doctor wey dey chop public health like food, Dr. Laz Ude Eze don yan town/development unions for obodo Naija make dem follow pursue Coro komot for obodo Naija. He wan make every community set up Village Development Committee (VDC) and Ward Development Committees (WDC) wey go help make hospitals do better for their communities, especially in preventing Coro spread. He talk dis one when he dey answer questions from Jude Geo-man on top Radio Sapientia 95.3 FM Onitsha during a radio interview today.
Dr. Eze bin give pass mark to Naija Centre for Disease Control (NCDC) on how dem dey work hard to pursue Coro komot for Naija. But he talk say dem jinja no go ever dey enough because we country health system dey weak. He beg kontri people make dem continue to cooperate with government, bone fake news and educate themselves on prevention.