Home Things wey happen See Why Lassa Fever dey Kill Plenty Naija Doctors and Health Workers...

See Why Lassa Fever dey Kill Plenty Naija Doctors and Health Workers Anyhow

487
0

Lassa Fever na one sickness wey dey spread easily from pesin to pesin. Na for inside Lassa Village for Borno State dem first see am in 1969. That time, e no waste time kill 2 nurses before dem bodi-mata people torchlight am see say na new virus. Since that time, the disease don kpai plenty doctors, nurses and other health workers.

Nurse Adesuyi – killed by Lassa in Ogun

On 1st April 2020, Lassa kpai one young doctor – Dr Philip Dzuana wey bin dey work for FMC Makurdi. We hear say na just 8 months wey he don work as he just komot from medical school. Presido of the National Association of Resident Doctors (NARD), Dr. Aliyu Sokomba talk say Dr. Dzuana na the 6th medical doctor wey don die of Lassa (in 2020?). He lament with vexation say government and hospital management no dey provide equipment wey doctors and other health workers suppose dey use dey protect themselves from Lassa, Coro and other diseases wey dey move from pesin to pesin.

Earlier this year, NARD bin tell tori people say Lassa don kpai 26 health workers for im message to government wey dem call “A Call to Action“. He lament say hazard allowee for doctors na only 5k and no life insurance, so the family of those wey die go just dey suffer. Presido Sokomba wan make government approve life insurance for doctors and increase the hazard allowee to 200k.

Late Dr. Idowu Ahmad – Lassa kill am in 2018

In January 2018, Lassa bin kpai 2 resident doctors – Dr Felix Ali and Dr Abel Sunday Udo and one nurse for inside Alex Ekwueme Federal University Teaching Hospital, Abakaliki, Ebonyi State. Same period, e kill Dr Idowu Ahmad, a young medico for FMC Lokoja. In 2016, e bin kpai Dr Ogboji Kelechi Aaron, a corper from Ebonyi wey dey serve for Kaduna. Nurses like Mr Henry Ehimati from Edo State, Mrs Omobolanle Adesuyi of FMC Abeokuta and more than 40 others for Ebonyi State alone don die from Lassa Fever. In fact, the fear of Lassa dey make health workers run komot from hospital sometimes because dem no get equipment to protect themselves.

Dr. Felix Ali and Dr Abel Sunday Udo – doctors wey Lassa kpai for AEFUTHA Abakaliki

We join dey beg government and ogas for different hospitals make dem provide enough protection equipment wey health workers need to work. E no pure make di few we get dey die anyhow from Lassa and other diseases wey their patient carry enter hospital.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.