Home Covid 19 See Tori about General Hospital Ikorodu wey Plenty People dey Talk About...

See Tori about General Hospital Ikorodu wey Plenty People dey Talk About for Twitwi

695
0

Coro don dey make things more and more difficult for everybody for obodo Naija. No be small thing since last Friday when ogbonge pesin for bodi mata, Dr. Laz Ude Eze post something on top im twi-twi page say General Hospital Ikorodu dey ask patients plus pregnant women to buy 2 sets of equipment for the protection of bodi-mata people (oyinbo call am personal protective equipment – PPE). The 2 PPE dey cost 6k. Dr. Eze wonder why na patients go dey buy dis equipment for bodi-mata people during dis period of Coro hunger. He kom ask wetin go happen to people wey no get 6k to buy PPE and begged Lagos State Government make dem do something to help kontri people.

A week ago, Lagos Governor bin announce free medical treatment especially for pregnant women during the Coro season.

Plenty people for twi-twi don dey talk about the post. Some bin ask why Lagos no use the billions wey ogbonge government and private donors give to buy PPE for di hospital. Others say GH Ikorodu dey notorious for anyhow behaviour. Some even use vex abuse Dr. Eze on why he go make dat kind post as a doctor wey im be. See some of di reactions below.

If you wan read more about di twi-twi and the comments, click here.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.