Ogbonge tori pesin wey work for more than 30 years and retirebut never tire for Nigerian Television Authority (NTA), Chief Moji Makanjuola don komot better message give tori people wey oyinbo dey call journalists. She talk say na tori people go help make the fight against Coro fit succeed for we kontri.
Aunty Moji (as plenty people dey call am) talk say e dey very importamkpa make tori people publish messages wey go help promote life of people, wey go help bring help to make dem survive hunger and hardship wey dey for land because of the stay-for-house-no-waka order of government. She squeeze face on how fake news take dey fly everywhere to mislead people but beg tori people make dem no follow spread those kind tori for any reason. She say tori people must increase dia jinja with correct tori about Coro prevention and the suffering of common people so that government, churches and people wey like to dey help others go fit provide food, clothe, drugs, counsel and other things dem need to survive.
Aunty Moji na chief for Offa Kwara State and na the Founder and Oga patapata for the International Society of Media in Public Health. Plenty tori people dey respect am like say tomorrow no dey due to many many better things she don do for the profession.