As some Naija people dey complain say army people dey behave anyhow dey violate their rights plus including killing of pesin for Delta State, the Army Headquarters don komot some phone numbers for public. Dem komot the numbers online through twi-twi and dem wan make Naija people report soldiers in any part of the kontri wey dey behave anyhow and unprofessional. Dem say make the message of complain get the name of the place where the anyhow behaviour happen, plus date and time sef.
See as dem komot am inside this image below:
Abeg knotri man, no find dem soldier trouble sha. Obey anything wey government talk.