Home Covid 19 Private Hospitals Wey Wan Dey Manage Coro Go Need Apply For Accreditation-Health...

Private Hospitals Wey Wan Dey Manage Coro Go Need Apply For Accreditation-Health Minister.

339
0
Dr Osagie Ehanire: Naija Bodi-mata Minister

Naija Minister of Health, Dr. Osagie Enahire been give the Presidential Task Force on Covid19 small yans, say Private Hospitals wey think say them fit manage Coro cases go need apply for accreditation.

Enahire say, the only place wey them dey manage Coro cases for now na government approved isolation centres nationwide, and any private hospital wey think say them fit manage Coro need to apply for accreditation.

The process no too long, once Ministry of Health receive the application, them go fix date wey them go come check the hospital facility and equipments, if everywhere and everything dey okay, them go approve the hospital.

Him come warn say, any hospital wey manage Coro cases without accreditation, them go revoke their licence.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.