Home Law Mata My Lassa Fever Tori Na for di Betterment of Ebonyi State, No...

My Lassa Fever Tori Na for di Betterment of Ebonyi State, No Be Fake – Chijioke Agwu, ToriPesin wey Gov. Umahi “ban for life”

938
0
Chijioke Agwu - tori pesin for The Sun in Ebonyi State

The tori pesin for The Sun newspaper inside Ebonyi State, Mr. Chijioke Agwu yan say he write tori about how Lassa Fever dey kpai people for Ebonyi State bcos na im state wey he love too much. Mr. Agwu wey Ebonyi Governor order im arrest last weekend and wey follow for di two journalists wey im “ban for life” 2 days ago from any govt premises; talk say people from villages inside Izzi land dey die anyhow from sickness wey resemble Lassa Fever. Because he wan make govt look into di matter, he come do torchlightment, follow plenty village people, hospital workers and public health experts sef talk before he write di tori.

Mr. Agwu talk say e surprise am say di govt order for im arrest and later ban am from Govt. House instead of going into di villages to find out wetin dey happen and prevent dying of im people. The tori pesin say di thing wey happen after im tori give am “mixed feelings”, wey mean say e dey sweet am dey pepper am at same time. But he vow say he no go carry fear dey do im work; instead, he go continue to dey write tori wey go help save lives and for di betterment of Ebonyi and Naija people. He say he no dey write fake tori at all, because im like im job and dey do im best to do am well and according by law.

He thank im newspaper – The Sun, di join-bodi of tori people (Nigerian Union of Journalists – NUJ) and all Ebonyi and Naija people wey give am support.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.