Naija prezido, Mohammadu Buhari been yan Naija people wetin dey occur for the country fight against Coro, him assure them say water no go pass garri.
PMB say, FCT, Lagos and Ogun go still dey on Lockdown until May 4th, but government dey plan ease the lockdown small from that 4th of May sha, some businesses and government offices go open, from people wey gats commot go need dey wear mask and observe other precautions wey them go set.
Him come thank our body-mata workers for the good work wey them dey do for this fight against Coro.