Ogbonge pesin wey sabi development of community well well, Mr. Charles Abani talk say lockdown alone no go pursue Coro komot for we kontri. He say from di way things dey happen, dis virus no go komot overnight even with di lockdown. According to di post wey he make for im facebook page and di talk he follow our tori pesin talk, Mr. Abani say e go better make we learn how our people go dey live, dey do dem work and dey pursue Coro till e go gradually disappear for we kontri.
He suggest make we end di lockdown make people find food chop because hunger don dey scatter area. He say make we use our brain well do wetin he use oyinbo call “combination of smart distancing and necessary working”. This sabinus for development mata say e go better make government for states put money for sensitisation of people, giving people food, making hospitals make dem dey work well well and make water dey make people fit dey wash hands well well.
He talk say di way wey plenti people wey dey do small work before dey beg moni diz days na confirmation say hunger virus don take over for we kontri. He come beg kontri people make dem cooperate well well with government make Coro fit komot for we kontri.