Home Things wey happen #LassaFever: Ondo carry 1st, Ebonyi carry 2nd as NCDC Confam 19 New...

#LassaFever: Ondo carry 1st, Ebonyi carry 2nd as NCDC Confam 19 New Cases in 1 Week

456
0

Kontri people, na double wahala for dead bodi as Lassa Fever and Coro dey hustle on who go punish Naija people pass. New informate wey the Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) komot show say dem confam 19 new cases between 22nd and 29th March 2020 (Week 13). Out of dem, 6 cases na for Ondo State, 5 na for Ebonyi State. NCDC data also show say the number of new cases don dey reduce since 6 weeks ago. Remember say na 51 new cases dem confam for Week 11 of the disease wey end on 15th March 2020. Overall, na Ondo, Edo and Ebonyi State Lassa Fever dey show pepper pass even though dem don confam cases for 26 states.

Na through regular washing of hand, cooking food well, keeping environment clean, pursuing of rats from home, washing food well, etc dem dey take prevent the disease. Health workers suppose dem shine dem eyes and protect themselves make dem no catch am from their patients.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.