As Coro bin keep Naija people indoors, Lassa Fever still dey show itself o. Inside the Week 13 Situation Report wey NCDC komot, the number of people wey Lassa Fever kpai don reach 185 as at 29th March 2020. New cases inside that week na 19 and e don increase the total confam cases to 951. The report show say new cases dey reduce every week by week since 6 weeks ago. Na 45 people dey undergo treatment.
See the message below as dem take summarise am.

