Kontri people, social media especially twi-twi dey on fire since yesterday when the video of where the big-grammar-talking Governor of Cross River State, Senator Ben Ayade tell im people say na only face mask dey prevent Coro. For inside the video, the governor blow plenty grammar wey we no understand di meaning as im people dey hail am. After that, he come show dem ankara face mask say anyobody wey wear am dey well covered against Coro and no go need observe social distancing again. He talk am as he dey launch “No Mask No Movement” for the state.
Kontri people for twi-twi (twitter) don dey react in different ways. Ogbonge lawyer and human rights activist, Prof. Chidi Odinkalu call am ‘Covidiot’ and ‘Little Napoleon’ wey dey mislead im people. Edward Akinlade say make dem go torchlight am for “Yaba (Left) Centre”. Mazi Idika talk say na clown, say im dey behave like small boy wey wan impress girl wey im dey toast. Kareem Kehinde reaction na “Mad People Everywhere!”
Wtin be your own reaction to this talk by Governor Ayade?