The Oga Seke to Ogbonge Govt, Mr. Boss Mustapha don tell the National Assembly say the wowoness and and decay wey he don see for Naija health sector shock am well well. Mr. Mustapha wey be the Chairmoo of the Presidoo Task Force on Coro talk dis one today when dem meet the Senate Presido, Senator Ahmed Lawan and Oga Speaker Femi Gbajabiamila to brief dem on Coro control for Naija. He say dis Coro work im follow do don open im eyes well well and im gree dat plenty work dey to make bodi-mata system dey kajad for we country.
As Oga SGF don see as things be by himself, we hope say e go explain to Oga Presido well make dem put health as number one for budget.