Home Covid 19 Dr. Deji Adeleke, Papa Davido, Don Donate 750 Million Naira To Fight...

Dr. Deji Adeleke, Papa Davido, Don Donate 750 Million Naira To Fight Coro For Inside Naija.

856
0

Dr. Deji Adeleke, CEO of Pacific Holdings and papa of Nigerian mega super star, David Adeleke aka Davido don donate 500 million naira to Federal government of Nigeria and 250 million naira worth of bags of rice and beans to Osun state government, as support for the fight against Coro(Covid-19).

Davido announce this tori wey dey burst brain for him instagram on Teusday, 31st of March 2020. Them go share the bags of rice and beans to the 332 wards for Inside Osun state.

Adeleke family come advise people of Osun state make them dey house, make them take precautions, them come promise to always support the people of Osun state.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.